Tuesday, November 24, 2026 | Global Live Network
WATCH LIVE TV
BREAKING
Global Leaders Convene in Geneva to Finalize Historic AI Governance Treaty ๐Ÿ”ด HOT360 LIVE: Real-Time Verified Breaking News | International Video Broadcasts | Hot360 Radio 98.7 FM Online Stream
Nigeria News 4 min read

CBN ban forex sales to BDC go make Dollar strong, Naira weak - Operators - BBC

Wia dis foto come from, Getty Images Nigerians dey worry about how one ban wey di Central Bank of Nigeria (CBN) announce go affect di value of Naira for di kontri. Dis na after di CBN put leg for ground on Tuesday say...

CBN ban forex sales to BDC go make Dollar strong, Naira weak - Operators - BBC
Official Hot360 Story Flyer • Verified Editorial Broadcast

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigerians dey worry about how one ban wey di Central Bank of Nigeria (CBN) announce go affect di value of Naira for di kontri.

Dis na after di CBN put leg for ground on Tuesday say dem no go sell foreign exchange to Bureau De Change operators again.

Bureau De Change operators na companies wey get licence from CBN to trade and change currency for pipo but CBN say dia corruption too much.

CBN say dis ban go 'stabilize' di Naira, yet dis one no stop some Nigerian businesses to reason how dem go buy and keep plenty foreign currency like US dollars and Pounds sterling, because of fear say demand for dem go rise.

Mohammed Abdullah, wey bi official BDC operator agree say demand for foreign currency inside Nigeria go cause dia price to go up and Naira to go down.

"E no fit make Naira strongโ€ฆ wetin dem [CBN] dey do no make sense," Abdullah tell BBC.

Like Abdullah, oda BDC operators believe say di CBN ban on wetin dem dey take do business no fit hold for long.

"You sabi how many registered operators dey? Like 7000 and each one get like 5 staff. So all of dem go come lose dia job!" Abdullah wey dey based for Lagos bin hala.

• Nigeria govment introduce new changes to Waec, Neco exams to stop malpractice

• 'Dem neva serve me legally' - Pastor Jimmy Odukoya show up as Fountain of Life Church hold service despite court order

• Why Nigeria ban di use of Dr prefix for pipo wey no earn am from school

• Morocco and Senegal to know final judgement on winner of 2025 Afcon on Tuesday

End of Di one wey oda users dey read well well

• Why CBN, Nigerian banks want you to pay for USSD charges

• Dem dey use cryptopcurrency for illegal business, launder money, buy hard and illegal drugs- CBN

'No change today but e go soon happen'

Wia dis foto come from, AFP/GETTY

Wetin BBC torchlight for ground one day afta di ban na say di price of Naira against foreign currencies never change.

As at Wednesday 28 July, to buy $1 from BDC, pesin go need to drop N500 - di same amount wey e be on Tuesday when CBN comot di ban.

Anoda currency exchange operator Jubril Zubairu say "although di exchange rate never change e go soon happen. In some days," im tok, Dollar go begin go up.

But Dikko im colleague say e fit reach one month before price of foreign currencies begin go up, as banks begin to feel pressure of plenty demand from customers.

Founder of economy tori website Nairametrics, Ugo Obi-Chukwu torchlight say di ban go reduce di number of places wia customers fit exchange currency since na only banks remain as official place.

"BDCs wey no dey, go automatically put more pressure on bank branches," Obi-Chukwu bin tell Nairametrics as im warn about di situation. E also warn say banks no go fit cope with all di rush unless dem automate dia exchange service.

Even if CBN get correct intention to stabilize di Naira, dis announcement wey many no expect dey likely to create panic and shock, and wit all di challenges wey e go cause, di Naira fit no tanda like dem hope.

Quick Story Answers

What is the latest update on: CBN ban forex sales to BDC go make Dollar strong, Naira weak - Operators - BBC?
Wia dis foto come from, Getty Images Nigerians dey worry about how one ban wey di Central Bank of Nigeria (CBN) announce go affect di value of Naira for di kontri.
Where can I read the full Nigeria News report and watch updates?
Dis na after di CBN put leg for ground on Tuesday say dem no go sell foreign exchange to Bureau De Change operators again. Verified coverage is published on HOT360 ONLINE TV (hot360onlinetv.top).
2,160 readers

Related Stories

Reader Comments (2)

Join the Conversation
K
Kofi Boateng
11 hrs ago

Big love from Lagos! Keep the updates coming ๐Ÿ‡ณ๐Ÿ‡ฌ๐Ÿ”ฅ

๐Ÿ‘BIG RESPECT
A
Abdul-Rashid Alhassan
11 hrs ago

Sharp reporting as always! Hot360 never misses ๐Ÿ”ฅ

LIVE ON-AIR Hot360 Pulse Live FM 98.7 FM
Continuous Live Broadcast Stream • Click to tune in
Radio Portal
NON-STOP READER News Story 1
Ready to read all news non-stop...
Press Play to start continuous news audio broadcast.